Safest cities in the world 2023: Tokyo, Singapore, Osaka and Amsterdam top list while Lagos rank low

Publish date: 2024-07-12

6 December 2023

Di SCI report na data from 60 oda states wit details of di state security level.

Dem say Lagos performance na base on di security level of di state.

Dem dey carry out dis survey every year.

Despite dis report, Lagos na di commercial hub of Nigeria and about 25 million pipo dey live for inside di state.

Based on di report analysis, Lagos rank below Tokyo for Japan, Singapore Osaka for Japan and Amsterdam for Netherlands, wey rank as di top four cities.

SCI tok say Lagos for Africa and two oda cities for Americas and Asia rank lowest, Caracas for Venezuela and Yangon for Myanmar.

Di SCI rank 60 cities around di world base on digital security, health security, infrastructure, and personal safety. Dem score dis cities between 0 to 100 point Dis report dey important because of di quality of life for di population of humans wey bin dey live for dis cities. Also, anoda important factor be di level of sucess of mega cities and how pipo fit travel safely for di environment.

How dem rank di 60 cities globally

Asia cities na six of di top ten safest kontri on di list; Tokyo, Singapore, and Osaka dey lead for safety while Johannesburg for South Africa wey dem rank as di 44th safest city na di first Africa kontri inside di list.

Dis na di rankings of di cities according to di safest;

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomp5voK3Hq8bKaZuo